Amadi preek fine no be small. E fine die! E be like dark chocolate. The vein wey dey show when e rise, join wetin give the preek better swagger. The one wey come totori me pass na say the cap of the preek na pink. Shuo! How prick go fine like say dem one put am for Museum or art exhibition? If you look the preek when e never rise, you go think say no be something dey there. But once e stand up for action like this, na better machine gun you go see. Na that transformation burst my head.

The night when I and Amadi meet, my body sweet me well well I no go lie. Na so body still sweet am too. As soon as our body collabo, we no fit leave each other again. Na so we begin dey fuck like say tomorrow no dey. We fuck 2 times that night. The next day we increase am go three times.

I know say you go like hear everything, but I go just tell you about one of the rounds wey sweet my belle pass. That na the second round of the next day. We dey bed cuddle dey watch one film like that. I no remember the name of the film but one thing wey I remember na how e done take use e penis to make my body coole with one round that morning. The thing be say, e mind really dey the film so I just say make I relax and leave am to watch. You know the story of the patient dog and the fattest bone abi? Na so e happen for me. The only difference na say my patience lead me to chop another round of better preek and correct fuck for Amadi hand.

As the film dey go, two people wey dey inside start to kiss. Na once I feel Amadi preek jump up like say na Olympics e dey. E done set! Before those people for the film go act another scene, me and Amadi tongue and lip done start our own action. As the film tough reach, Amadi know say na wetin we dey do tough pass.

E focus on my mouth and my tongue. After small time, e look me for my eye come smile, then back to my mouth. Small time, he whisper for my ear say, “Baby, you want this dick abi”? The tone wey e take ask me this question na very soft one. I no even sure say e mouth move sef. E nor even give me time to respond before e lip connect to my own again like bluetooth. Before you know, Amadi slide e body on top of me, and the way e dey kiss me come strong pass before. Deep. Small time e start to brush my nipple with e thumb. As e dey do that one, me sef go down begin touch myself where e for dey happen. I start to finger my hole. From time to time I go remove my finger come lick am. Sometimes I go put my finger for e mouth make e for taste am too. As this one dey go on, Amadi dey gently bite my top lip and dey suck am too.

Even though say I dey finger myself I no pull the knicker wey I wear. I just adjust am in a way wey go fit make me fit play with my hole. I want suck Amadi preek but he say no. At that point the konji want finish am so na action wey go make me feel e preek for my warm hole na him he want. Amadi turn me make I use my belle face the bed. The next thing wey I start to feel na e preek wey dey enter my shobos. Small time my shobos full like person wey chop overfeeding. I still wear my knicker and e still were e own. We just adjust am so that we go fit mekwe. I like the thing die. If man wear cloth when e dey fuck me, e dey make me they happy die. The thrill as oyibo dey call am dey make my mind dey to collect the preek well.

Before you know, e put pillow under my waist so that my yansh go fit set well so that e preek go fit they go inside and come out easily. As e dey fuck me na so all my body dey shake. E be like say na injection e dey give me. E just dey shook me like say tomorrow no dey.

Small time e remove e preek come start to dey kiss me. As e dey kiss me, the only thing wey I want na for am to continue to fuck me. After small time e ask me say “Babe, you miss my preek abi?” He come laugh as I say yes. One thing na say, ashawo no dey shame for preek matter. The next thing wey happen na something wey I no expect. E clap my yansh hard sotey e echo. E come shook e preek inside me with one long, correct stroke. Surprise want kill me. Na once I start to twist for bed. I come dey suck in air through my teeth. The way I take moan make fear catch me. Na then I know say I really need e preek, I need am die!

“Babe, you too sweet to fuck!” He talk like that as e dey grind hard against my hole and they move e waist and hips like person wey dey dance makosa. Na so e dey open me, they drill deep inside me like say all the remaining oil wey dey Nigeria dey inside my hole. My body mold around e body and my hole grip e preek tight. E draw e preek back slowly until only the head of e preek dey inside me, then e come start to stab me with preek without mercy. Omo body just dey sweet me as e continue. E just begin dey use e preek play with my prostate until my body start to shake because of how e preek dey sweet me as e dey fuck me.

The way my body dey do me come be like say electric dey shock me from inside my body go reach my fingers. I hang for this position when l start to feel something wey warm they flood deep inside my hole. “Oh, fuck. I done dey cum!” na wetin e start to shout. E preek come be like say e dey swell up for inside my body sotey I start to feel the vein wey dey the preek. E continue to dey fuck me even as e dey moan. As e cum finish, e come wrap me for he arms, e finger come dey play with my own preek.

After sometime e start to kiss me and finger me. I begin to wank. “I…….!” I choke as I want tell am say I done dey cum. I no fit talk because na better orgasm e just give me. After we clean up, we go back to the film like say nothing happen.

 

       Written By:

             @Kinkstar_ (twitter)